Put on my fire
This should be my first pidgin poem…its actually a translation of Rekindle my Fire . I made it for some competition like that…whatever happened to that competition, i wonder…i hope i didnt stray too much while trying to translate it to pidgin..
E don tei wey I dey tanda only me wen i dey with my paddy dem,
E don tei wey only me dey waka for insyd of crowd,
I don see plenty-plenty faces wella,
But all of dem too resemble each & other.
The voices wey I dey hear too sound the same,
E dey like wan anoying whistle
Oyibo go say e dey: mono and tonous.
I don shake hands tire with plenty people dem,
Pako own rough, and Ajebuta soft
But wen I try to rizin am
I no fit even rememba which pesin I shake now, now.
I been smile for pesin wey I think say I know
And even come ansa say I dey fine
But for inside of my bodi, I know say no be so
E don tei wey no be so, e don tei wella.
I don loss finish, even my hope, na small wey remain.
I just wish say I fit put on the fire
Wey been dey burn for inside my bodi,
Then I go tanda wella to tok when people dey talk
But my spirit don nearly die and I no see rizin to tanda.
E be like say I go continue to wakabout
Then smile and wave my hand when people wave give me.
I go wait for make the sun wake up
And for wen the moon enter position for night
Everyday go be a new day but to me
E go be like any other day.
<<<If e get as e dey do you and na only u dey, no allow make SHY stop you to knack the folo-folo botton for make i come join you dey, you go see am for the top and on the gight hand side of this page>>>
hahaha…this is good
my favorite line “Oyibo go say e dey: mono and tonous.”
Guess i didnt stray much then…Thanks a lot
Not bad..
I can comprehend d english version more though
Truthfully…me too